Culled From Vanguard.
This young man had a dangerous brush with a moving train along the Airport Bus Stop, Ikeja end of the Agege Motor Road Train Track. He was said to be fully kitted with his 'Head Phone' over his head, listening to music. He has since been rushed to the Ikeja General Hospital, lucky to be alive.
- Mumu boy...you dey lucky to be alive. We must put you for Guiness Book of Records.
- Head phone say make you no shine your eyes? Abi you dey blind too?
- Na God save you o. I go advise say make dem call village meeting for your head... since you commot village say na for Lagos you wan come die.
- Anyway God dey your side. You never reach your own 'bus stop' bcos even 'malu' (cow) wey jam train no dey survive...na yamutu dede ni.
- Which music you be dey listen to sef??? Ee no fit pass 'snoop dog', abi all those yeye naija pangolo music. D person wey sing d song dey make eem millions jeje... you wan die bcos you like him music too much. Bloody fool!!!

No comments:
Post a Comment