- NO CONDITION IS PERMANENT...from Soccer Star to APETESHI/OGOGORO MASTER.
- Dis guy na fish now o...na so so drink ee dey drink.
- Ee come be like say alcohol na food.
- Yoruba tok say ENI LORI KONI FILA (person wey get head no get cap). Na person wey no get head come get cap.
- D kain money wey dis MUMU don touch before....no be small o. But now ee no get SHI SHI for pocket. Na for street ee dey even sleep sometimes sef.
- Anyway Na God sabi as ee dey do eem tin.
- If you give some beta people dat same money, walahi dem go spend am KORRECT...even sef d money go get INSTANT RESPECT. Se una know wettin I mean...when money respect person. Not d opposite.
No comments:
Post a Comment