.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Friday 18 October 2013

LATE ADMIRAL AIKHOMU'S WIFE AND CHILDREN KIDNAPPED!!!







NAIJABLAB has just received news that the wife of the late Admiral Augustus Aikhomu, (one-time Nigerian 2nd-in-Command), has been kidnapped along with two of her children along the dreaded Benin-Auchi Road.They had just flown in from Lagos, and were returning home to Iruah. Their driver was killed.

  • It is obviously going to get worse before it gets better...it seems.
  • Nawa o...dis young men no fear anytin o. No be today Gov. Oshiomhole sign Law say Kidnapping go become death sentence? Abi dem no dey read paper? Or dem no read MY BLOG??? lol. Sebi Mike Ozekhome tok say dem be graduates, and dem sabi book?.
  • And see poor ME...I be wan go Benin go dey SHAKO for Main Road like say Governor go save my arse??? Naim be say dem for just CATCH MY POOR ARSE...chei!!! Dem for come dey demand ££££ for my own mata sef. Na CHINEKE GOD save me ooooo....walahi.
  • Dis bastards have NOTIN TO LOSE o...Dem dey ready for anytin..even to die. Dis no be joke.
  • Dis wan na GARRI WEY DON PASS WATER ke...no be water wey pass garri.
  • Dis Edo people sef...dats why I like dem. Dem be PERFECTIONISTS...anytin wey dem wan do, na to full perfection. If dem wan TIF...na korrect wans like Aninih go surface. If dem wan kidnap sef na d OGBOLOGBO kidnappers go come forward.
  • Una wey una dey kidnap for other kwe-kwe States for Nigeria...se una tink say una sabi work??? Walahi make u go TRY EDO KIDNAPPERS....dem get PHD holders sef....doctorate degree for kidnapping.
  • Why you tink say their Governor dey HANG DEM? Na dem go first pass law for death sentence for kidnapping too...and yet DEM NO GIVE A SHIT....Apuruka people.

No comments:

Post a Comment