.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Sunday, 3 November 2013

JIM IYKE WANTS TO MARRY NADIA BUARI.



The Nigerian Nollywood Actor, Jim Iyke has said he has plans to marry Ghanaian Actress, Nadia Buari.

  • Dis guy don change o....THANK GOD for Holly Spirit wey enter eem body.
  • If na so dis DELIVERANCE dey work, then all awa Nigerian actors and actresses need it FAST in order to stop their CHRONIC-ASHAWOISM.

PARTIAL ECLIPSE OF THE SUN IN NIGERIA.

Photo: Partial eclipse of the Sun in Lagos

Lagos, today experienced a partial Eclipse of the Sun!!!

  • NICEEE!!!
  • Not a common sight.

UK SCRAPS VISA BOND FOR AFRICANS AND ASIANS.

Elizabeth II and Cameron

The UK has announced plans to scrap the controversial Visa Bond of £3,000 imposed on the citizens/visa applicants from countries like Nigeria, Ghana, Bangladesh, Pakistan, Insia and Sri Lanka. This was initially done in order to deter visa applicants from over staying their six-month visa.

  • Oyinbo ....una dey craze o....Una be REAL OPPRESSORS. Ee dey for una blood. Una sabi to kick man wey don already fall for ground...na una speciality be dat.
  • Se una tink say na so money go dey flow from poor countries come una country...abi?
  • Even sef JESUS CHRIST no charge dat kain money for us to enter d Kingdom of Heaven. Wettin dey una country wey people must pay money to see...on top d ticket money and so on.
  • Na God save una....una for see d negative effect of it...na dat time Naija for INVADE una country well well...bcos I kno my people. Dem no go pay £3,000 to come look LONDON BRIDGE come return go home...just like dat? You dey joke. Naija people for dig ground enter HOLE for UK...even crack team of World-Class Investigators no for fit dig dem out.
  • If una kno wettin good for una, make una just leave us make we dey go dey come...notin spoil o...unless una wan spoil am by una selves.
  • Even sef dem Paki people for deal with una...no be small. Their own wayo pass Naija own by far. We we be apprentice beside dem. I hear say one Mr. KHAN fit use eem passport bring 100 Mr. KHANS enter UK. Dat na OGBONGE wayo people. 
  • Yoruba tok say..OYINBO GO (oyinbo mumu).

Saturday, 2 November 2013

MEN WITH FAT NECKS MORE LIKELY TO SUFFER ERECTILE DYSFUNCTION!!!



Scientists at the University School of Medicine in Ankara, Turkey have concluded that men with over 16.3ins (35cms) neck size are more likely to suffer from erectile dysfunction, and lack of PERFORMANCE in bed. They arrived at this result when they tested 92 men aged between 40-60 years of age. They are more likely to have metabolic syndrome of diabetes, high blood pressure, and obesity which affect sexual performance. Having a large neck also leads to sleep apnoea which contributes to lack of DESIRE!!!

  • Cheiiii!!! Una don come again o. 
  • Naim be say over half of awa Naija BIG MEN (rich men) no fit 4uk. I don catch una today...u dis Senators, Governors and Politicians. So na so so sleep una dey sleep for night. What a WASTE!!! Una just dey waste all those fine fine babes wey una dey take una money carry...abi?
  • Bcos for my country if you no get FAT NECK you no be big man ke...even some gatemen and maiguard no go even open gate for you sef.
  • Police sef go yab you for check-point like say you be wan small student.
  • At least dis na consolation for those with thin necks...even if you no get money for pocket...but you sabi 4UK pass useless BIG MEN with BOKOTO and KPOMO necks.
  • Nice wan....make una go dey chop CARROTS. If dem hear dis, some of dem no go mind to even IMPORT their carrots sef...yeye people.

CARROTS ARE GOOD FOR SPERM PRODUCTION IN MEN!!!



Researchers at Harvard University have concluded that carrots can improve production of sperms in men. This is because of the pigments called carotenoids which the body converts into health-boosting antioxidants. The antioxidants further help to neutralize free radicals and destructive groups of atoms that are a by-product of metabolism, which are capable of damaging cell membranes and DNA. Carrots can improve sperm quality by between 6.5 to 8%, says the Report. In addition carrots have been traditionally known for improving eye health.

  • Ehennn..wahala don come o.
  • I sure say some of una go go charter carrot for market tomorrow.
  • Well as for those of you wey don take prick do beta tin finish (born pikins), una no need to lose sleep.
  • Na d younger men I dey sorry for...all dis yamayama food wey una dey chop dis days sef dey fit demobilize prick...foods wey oyinbo don lace with too much PRESERVATIVES and fertilizers.
  • D time wey we dey young we dey drink DONGO YARO leaves wey dem cook for on top faya, by force. O boy d tin bitter no be small. How many young people dis days fit drink am?
  • Na those kain tins make awa MR MAN to Strong well well. I trust awa parents of those days. Dem prepare road for us, bcos dem want grand-children by force.  Lol.



Friday, 1 November 2013

IGBINEDION OPENS MULTI-MILLION NAIRA CINEMA & ENTERTAINMENT CENTRE IN BENIN.



The Esama of Benin Kingdom, Chief Gabriel Igbinedion has announced the impending grand opening of a multi-million Naira Cinema and Events Centre in Benin-City. It is a gigantic structure that will be known as KADA Cinemas and Entertainment Centre, with 5 Cinema Halls, Banking Halls, Sports Bar, Tennis Complex, Chinese Restaurant, VIP Dining Halls, Coffee Shops, Gift Shops, and Bureau De Change. He claims it will be the best thing that happened to Benin-City.

  • Welcome Sir...just make sure say una maintain am well well.
  • Una no kuku get maintenance culture for Naija...D tin go start well, but after wan year na story story.
  • Well it is a consolation dat una dey put back d money into d system where it came from in d first place....instead of going to waste your time and money for South Africa as una bin do before before. Capital flight wey no make sense...abi una tink say South Africans LOVE UNA? Na your money dem like....I mean awa money (bcos all na awa government money). Abi ke.
  • For Nigeria na person wey dem catch be tif. Any person wey CHOP and dem no catch, na SMART GUY.
  • In fact Lucky na real LUCKY boy!!! D moda4uka got away with a mere slap on d wrist....courtesy of awa CHOP-CHOP Judiciary.
  • Anyway sha....we are ALL EARS.

BUHARI SAYS BOKO-HARAM IS A SUBTERFUGE TO KILL THE NORTH!!!



Speaking recently at the Government House in Kano, ex-President and Army General, Muhamadu Buhari said Boko-Haram is a stigma imposed through a subtle political means!!!

  • You are JOKING...aren't you? Mr. General.
  • When you live in glass house, do not throw stones....dis is a lesson.
  • You...  BUHARI threw stones dat later ended breaking your 'glass house'.
  • Abi no be you tok say NIGERIA WILL BE UNGOVERNABLE IF YOU LOSE ELECTION???
  • You guys are so shallow dat you tink dat Nigerians do not remember little careless sectarian comments like dat. Dey sure go down in History.
  • So why are you now crying fowl??? Bcos you want to win election...abi?
  • You CREATED A MONSTER called BOKO-HARAM...so you are d only one who can control your monster.
  • So please do not giv me dat BULL-SHIT...Its now OVER TO YOU...General Buhari...(The Autocrat and Despot).
  • You tok about 'killing the North'. Is it possible to KILL a dead thing??? I ask.
  • Is it not people like you dat killed your own North by yourself? What have you Northern leaders done for your North in d 35years dat you ruled Nigeria? In fact what have you done for Nigeria as a whole?
  • I REPEAT...It is only General Gowon dat has gone down well in Nigerian History as having done SOMETHING for d masses of dat country. D rest of una be BOMBO-CLAT. PUSSY-CLAT. BLOOD-CLAT....gbogbo e gbogbo e.