.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Thursday, 26 September 2013

TASTEE FRIED CHICKEN OWNER'S SON IS DEAD.

olubunmi adedayo is dead

The only son/child of the owner of the famous Tastee Fried Chicken, Olubunmi Adebayo, is dead. He was the CEO of the Chain of Restaurants started by his mother, Mrs. Olayinka Adebayo. He was air-lifted to the USA on life-support, before he gave up the ghost on Tuesday, 24th September. He died from HEART-DISEASE. It would be recalled that he celebrated his High-Society Wedding on 31st of January, 2009, in Dubai. He is survived by a wife and two kids.

  • RIP....too young to GO!!!
  • Naija people...make una dey watch una health o.
  • HEALTH is WEALTH.
  • My heart goes to her parents, wife and kids. He was a pleasantly humble guy.
  • He reached his own BUS-STOP.

Wednesday, 25 September 2013

TOO MUCH FOOD IS OFTEN THE PROBLEM.

granny

This 64 year old woman weighed 17st 12Ib, and had breathing problem. She dropped down to 8st 7Ib after doctors told her she stood the chance of dying. She changed her diet and took up WALKING.

  • Se una don hear...una wey dey chop RICE for morning, EBA for afternoon, and POUNDED-YAM for night....na garbage in, garbage out o.
  • I hear say some people sef dey chop am dey come NAK Beer (GULDER) on top...korrect. Dat na body-assault.
  • To gain weight dey easy, but to lose am na WAHALA.
  • And for Naija, I don notice say ee hard for BIG-MAN to walk...na so so moto with AC naim dem dey take waka. Dem no dey even drive sef...wettin dem dey take driver do for Naija (dozen a kobo). Even sef to buy tins/provisions dey easy for GO-SLOW....dem go dey beg you sef, dey run after your moto. Dats why una big-men dey PEG-OFF any how like flies, after amassing all dat money/ota/ego/kudi. Una no dey do exercise. Especially those wey live for high-density areas like Lagos Mainland, wey space no dey to say you wan stroll. Dat wan be say na DANFO go break your leg....abi make Area Boys tear your sokoto. Lol. 
  • We wey dey for LEKKI wey fresh air and open space dey...you go notice say we dey live longer. Lol. Even poor man for Lekki dey live stress-free life pass big man for mainland....except dis wan wey Fashola and him broda Tinubu don make life a nightmare for those along d AJAH axis....dat una express road wey no go ever finish.

GOOD EXAMPLE OF 'BAD PARENTING'.

Bad example: A woman was spotted drinking from a can of lager outside a primary school in Grimsby, north east Lincolnshire. She is thought to be a parent waiting to pick her child up

The woman in this photo was seen drinking BEER from a can, while waiting outside a primary school for her child to close.

  • Dis na d original CHAV...dem boku for London. Even her partner sef no dey work. Not bcos work no dey, but bcos dem kno say government go look after dem.
  • No be dem fault...weda she work o, or she no work o...she go collect OWO BABA (welfare) money from government. Even her pikin wey dey school sef dey chop FREE LUNCH for school. She reach home, na government dey pay eem house rent. Wettin remain?
  • Dat na d difference between poor people for advanced countries, and poor people for awa own Naija. Even sef dis trash wey una see for dis foto so dey live beta life pass a whole primary school teacher for awa country.
  • Dat is why d tin dey VEX me at times...bcos no be say Naija people dey ask for too much...just BASIC TINS. Dem no even want OWO BABA...just give us employment, Nepa, water, housing, health service...simple tins.

CULT IN NASARAWA BURY A WHOLE CAR, AND ITS PASSENGERS!!!

Shock over car buried with bodies

This car was discovered buried in a pit near a riverside area of Obi Local Government, Nasarawa. It contained the dead bodies of three persons, namely the MD of a Police Micro-Finance Bank, the Manager of the Bank's Abuja Branch, and their driver. They were said to have been returning from a Wedding Ceremony of the child of the Police Commissioner-in-Charge of Co-operative. They were ambushed by suspected OMBATSE CULT GROUP, who have been terrorizing Nassarawa State.

  • Dis is ridiculous...to bury a whole car with people? 
  • Dis are SINISTER lots. If we combine dis kain people with awa Boko-Nonsense people, then WAHALA don come be dat o. I hear dey used juju d other day to kill a squadron of police men drafted to arrest dem. Naim be say dey are now ABOVE D LAW ke.
  • Nigeria is TRULY ON FAYA....no wonder Jonah dey beg Obama to come FIX Nigeria.
  • Bottom line be say na serious unemployment, and UTTER NEGLECT of the poor masses dey foment dis kain bull-shit. People wey no see any FUTURE for dem lives, and are ready to KILL and DIE demselves. 
  • NA WE GO FIX dis shit awaselves o...and if you ask me HOW...I will say we should beg OMBATSE to dig a bigger PIT and INCINERATE all awa leaders before burying dem with all their fine-fine BULLET-PROOF cars. (Yes...Bullet-Proof Cars, when some Nigerians no fit chop one meal in a day!!!) 
  • And then we start afresh....SHIKENA.

SPOT THE DIFFERENCE!!!



Last night Kenya's President Uhuru Kenyatta addressed the nation to say the mall was under state control again

I REST MY CASE.

NOSY HEAD!!!

Xiaolian, 22, had a new nose grown on his forehead after his original one was irreparably damaged in a traffic accident. The new nose was sculpted from cartilage taken from his ribs

This 22 year-old Chinese dude was involved in a car accident, whereby his nose/cartilage was damaged beyond repairs. Surgeons in Fuzhou, China were able to RE-CONSTRUCT a nose on his forehead using cartilage from his ribs. What a NOSY HEAD!!!

  • Ee get as dis wan be o...poor dude. If you be Naija man, no woman go near you...unless na you be ADENUGA or DANGOTE.
  • So far you fit take d nose breath...who cares about smelling shit? If shit like make ee smell, which wan concern you. Wettin dey important be say you get NOSE.

JONATHAN ADDRESSES THE UNITED NATIONS GENERAL ASSEMBLY.



President Goodluck Jonathan, yesterday, addressed the UN General Assembly in New York., demanding for a decentralization/democratization of its Security Council in line with GLOBAL REALITY. He said this will allow for equity, fairness and justice, as well as sense of inclusiveness. He once again asked for a Non-Permanent seat for Nigeria on the UN Security Council, and got the support of many member countries.

  • Nice to kno say no be only tea and coffee una go dey drink for dat side.
  • It is REALLY hightime...wettin oyinbo people expect sef. Typical...Oyinbo na original OPPRESSOR...If una no DEMAND from oyinbo dem go continue to use una as statistics to complete the numbers....dey warm seat for UN Assembly every year. Oyinbo no give a shit about you guys...Na only if una OPEN MOUTH una go get response.
  • D damn UN was originally set up by oyinbos, for oyinbos. Dem no expect say make we black people get voice. Dats why dem no put us for security council in d first place.
  • My TAKE on dis matter be say if dem no gree us...make we threaten to pull out...full stop.
  • Mumu people...dats why Al Qaeda dey hammer dem. If to say dem get black countries for security council before now, dem for fit UNDERSTAND d approach as to handle those 4ukas called Al Qaeda....now dem don let dem grow wings come dey hammer d whole world. See 4ukin Boko-Haram, and dis yeye Al Shabab for Somalia. Na bcos Oyinbo no handle dis shitty Al Quaeda well..dats why all dis useless off-shoots come GROW like cancer around d world.
  • Oyinbo go dey tok BULL-SHIT human Rights and Civil rights...when you should HAMMER d Moda4kas...tis d only language dem understand for their own culture. Na we black people sabi awaselves well well. Once you open eye for oyinbo small...you go get your way.
  • Me i don tok am say right from time immemorial...muslim and xtians dey live for naija. And each person respect d other person...no SHISHI. But na only recently muslims come dey tell xtians say ee get as ee be...say make xtians convert by force. NA OYINBO CAUSE DIS NONSENSE o...una don give dem too much allowance. 
  • For example if you go Saudi Arabia, you no go fit erect CHURCH just like dat. Dem never born d Xtian or Bishop. But if you come central London you fit build MOSQUE wey big pass d central mosque for Saudi Arabia sef, and dem go even give you grants/loan from public funds. If u like sef build am next door to ST. PAUL'S CATHEDRAL...eh hennn!!!. Oyinbo say na CIVIL RIGHTS....dem go even collect signatures for you sef, CARRY GO table for Parliament. MUMURITY at its height. 
  • Recently I hear say oyinbo wan make law say make people no dey wear crucifix or cross for neck-chain again for public place!!! Bcos dem say it is offensive to muslims???? Dem don dey craze be dat. Small time dem go say make we no dey chop pork for awa house...abi?
  • Well...I dey laugh. Na dat Civil Rights go kill una....GASKIYA.