.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Saturday 5 October 2013

THE PROPOSED 4X4 ROLLS-ROYCE.

Glimpse to the future: This is how a planned 4X4 vehicle by Rolls Royce, the car company's first, could look

ROLLS-ROYCE HAS DRAWN UP PLANS FOR A RADICAL 4X4 ROLLER, TO BE RELEASED IN 2017. (See the replica above)

  • O boy...me I don book my own o...and ee no too cost. Afterall wetin person go take dis money do sef. 
  • But as for those of you wey no get money to deposit rite NOW, we fit still put down una names for WAITING LIST while you go out and source/work hard for d money..., plus una must go church go do night vigil o....you kno say 2017 is still a long way away, so una get time well well. Anytin can happen before then IJN (In Jesus Name)...amen. 
  • You fit go win Pool sef before dat time....na ya luck. D good tin about DREAMING be say NA FREE of charge...dats why I like am.
  • Anyway d car fine sha. I don even choose my own colour sef. When dat time come, i go decide weda i wan bring am come Nigeria. Maybe una go don solve una kidnap problem by then...plus una must to eradicate DANFO and MOLUE from Lagos Streets if una want make I LAND....and those yeye OKADA people...make dem no go scratch d damn tin for me.

No comments:

Post a Comment