.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Tuesday 1 October 2013

TIGHT BELTS CAN CAUSE THROAT CANCER!!!

People who wear a tight belt are at greater risk of developing throat cancer, new research suggests

Scientists and Researchers at the Glasgow and Strathclyde Universities in Scotland, UK,  have warned that using tight waist belts can force stomach acid into the oesophagus where it damages cells, and therefore can become cancerous in the throat area. The risk is greatest in over-weight people.

  • Una don start o....very soon una go say make we no chop or shit again sef.
  • Everybody dey tok eem own...bcos una wan enter book.
  • If you tie belt and d tin tight...na person go tell you before you loose am?
  • Anyway all dat wan no concern awa young boys dis days...sebi dem no dey wear belt. D tin too dey vex me when I see young people dey wear trousers and dey come show their DIRTY PANT for public. Dat wan no be fashion....Na NONSENSICAL NONSENSE. 
  • D other day I see wan mechanic guy do am for inside Bank for Nigeria...d tin vex me as I dey imagine as d Pant (PAINT) go take dirty reach for inside inside....I reach home dat day I no fit chop as I come dey remember d tin wey my eyes see....babanla nonsense. And no be say d guy come collect beta money sef...only 5 thousand naira....plus all d guy wey he do....and environmental POLLUTION on top. And u kno say AC no dey work well well for Naija Banks. D whole place come dey smell like GREASE and BAD MESS (soak-away)....combined.

No comments:

Post a Comment