.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Wednesday 9 October 2013

YES OR NO!!!

Dr Kamal Abusin, 54, is accused of sexually assaulting a young woman during an examination in A&E

Questioned: Dr Kamal Abusin said he 'vehemently denied' all accusations

This 54 year old Sudanese-Born UK Medical Doctor was made to appear before a Cardiff Crown Court for conduct bordering on Professional Ethics. He was accused by a 19-year old patient of GROPING her breasts while conducting a medical examination of her stomach. He vehemently DENIED all charges, and the trial continues.

  • D place where man no dey...Na only GOD dey there.
  • I dey pray God make ee no be true o...bcos na all of us black people MESS go dey smell for awa body.
  • Yoruba say...'Oun tio da, o da'...naim be say WETTIN NO GOOD...NO GOOD....haba!!!
  • On d other hand, dem sure say dis man na 54 so...bcos ee be like real old papa ke.
  • But make we tok true...awa wives dey try for us o. Bcos everytime wey I see dis kain tin for paper you go notice say d Woman (wife) go STAND kampe by her man....weda he dey guilty or not. In fact na dat wan sef dey deceive people pass, bcos everybody go look d fine woman and say...NO WAY...ee no possible make man wey get beta woman like dis commit dat yeye crime. Sebi una remember dat bad boy...PRESIDENT CLINTON own. Na so d man deceive us sotay, we almost believe am sef.
  • But we men na REAL NAMA we be....some of us sef no beta pass SUYA MEAT.
  • Me I don kuku tok am say if to say I be doctor, I go dey take wan small belt like dat dey tie my prick to my left leg (thigh)....bcos at times d tin go fit go dey misbehave when you no invite am. Body no be FAYAWOOD. Lol.
  • But dat wan no mean say bcos u dey see free show everyday, say make you come dey touch women BOBBI anyhow ke...dat wan na FAYA you touch so. Naim be say your WATER DON PASS YOUR GARRI.

No comments:

Post a Comment