WHAT IS WRONG WITH A BIT OF FLESH AND 'MEAT'???
- Choose ONE.
- Wettin be dissss? Chineke God. Dis na d original AGARACHA (Apoka/Bones/egungun).
- You dis awa African women sef...una dey try do like oyinbo people? Ee no go work o. Bcos God don give una chunky body wey we d men LIKE. Even sef some of my guys dey prefer OROBO (jumbo size).....even tho dat wan pass me small (lol). You kno say me I be small boy!!!
- What do you expect...oyinbo dey chop salad. Una dey chop Akpu/Eba/Fufu/Iyan/Amala....and you wan slim. Even sef oyinbo dey do plastic/artificial YANSH dis days. Dat is to tell you say una dey KAMPE.
- Abeg make una no worry una sef...we love una d way una be. Nottin spoil if woman get meat for body. No be BONGAFISH man wan chop....meat na GADGET for ....you knowwwww...choki-choki. Wettin man wan take bone do?
- Make una behave una sef o...before we vex.
No comments:
Post a Comment