There are plans by Lagos State Government to 'issue Bonds' totaling 87.5 billion before the end of 2013 in order to TAKE OVER the Concession Rights of the Lekki-Epe Expressway from the Lekki Concession Company (LCC)!!!
- Hmmmm Nkan N'be!!! D tin wey dis Naira go cause for awa country....na only God go settle am.
- FASH....you dey disappoint me. I tink say you be prudent governor? How can you rationalize dat. It is like buying a DEAD COMPANY from d stock market?...on what basis?
- How d hell do you want to waste awa money buying d 'Right' from a Company dat belongs to your predecessor? You are basically enriching Tinubu further....aren't you? WHAT RIGHTS are you buying? A Negative Right!!!
- That Company has refused to perform for some years now...dey started off sharp sharp, thinking dey could charge Lagosians as much as 1000naira to cross ordinary Toll Gate. When dey saw d angry reactions of residents in Lekki, dey now decided to lose interest in d Road Construction...dat is why dey spent over a year between Chevron axis and d Ajah axis...doing shoddy work, and causing traffic nightmare to poor residents.
- Una don go do backyard meeting, decide say una go still collect dat MONEY from us...abi?
- FASH...your problem be say, even tho you get small conscience...you dey FEAR Tinubu bcos na him put you there.
- Anyway...wettin man no see....GOD DEY SEE. Make una search una conscience, bcos one day na wan day...una no go dey there again o.
- THE ONLY THING CONSTANT IN LIFE IS 'CHANGE'.
No comments:
Post a Comment