.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Friday, 14 March 2014

PAUL OKOYE AND BABE!!!









Nigerian Music Star, Paul Okoye posts pis of himself and his intended wife, Anita Isama. It would be recalled that his twin brother, Peter Okoye (also a musician), got married late last year.

  • Congrats Buddy!!!
  • At least you and your broda sabi choose FINE BABES....Na me una take dat wan resemble. Good for you bud!!!.
  • But dis wan wey you wan tear d babe leg for foto...when you never even pay bride price yet...nawa o. Na so d TIN sweet you? Yoruba people go say SO FE FA NITAN YA NI???...meaning Make U no tear eem PAYAN.
  • You go try do am slow slow o (silo silo). No rushing, ma broda. Na you get d TIN...no how, no how. lol.
  • I get wan friend like dat wey go marry UGLY BABE, after all of us don do SHINO sotay for school days with fine babes (including Miss Nigeria sef). When I come ask am say wettin happen? He tok say na bcos eem no want make other men dey shadow eem wife.....Na so I laugh sotay...I no fit laugh again.
  • Anyway me I tink it is a SIN for any fine boy to marry ugly babe. But it is OK for UGLY guys to marry fine babes....bcos na awa remnant (REMI) dem go get in any case. Bcos me (mysef) I am a very generous guy. lol.
  • But Paul..no be say you sef fine too much o. But sha you PASS small, bcos when MONEY/EGO/KUDI/$$$£££ come mix with small fine, d tin dey fit amount to PLENTY FINE. Hehehehe. Dat wan na PASS MARK for Naija....abi?

No comments:

Post a Comment