THIS INNOCENT LOOKING 'MONSTER', WILLIAM CORNICK, 16, GOT SENTENCED TO LIFE IN PRISON WITH A MINIMUM OF 20 YEARS BY A LEEDS CROWN COURT, UK, AFTER HE MURDERED HIS TEACHER (ABOVE) WHEN HE WAS AGED 15 YEARS.
HE HAD NO REMORSE, AND CALLED HER A F**KING BITCH THAT DESERVED MORE THAN DEATH!!!
- Hmmm...see as I open mouth.
- Well sha all I can say be say you stupidly rich Nigerians wey dey send una children abroad to do ordinary secondary school wey dem fit do for Nigeria...make una careful o. Bcos money no fit buy good manners o. Even sef money no fit buy LIFE.
- Sometimes sef...some of dis awa kids go reach oyinbo country and try to do more than oyinbo demselves....dey hang around with dis kain yeye child above...wey devil don build mansion for eem bele.
- For UK...oyinbo children don run out of good manners finito...dem no get RESPECT. So if una no guide una kids na wahala una dey invest in oooo...upon all d money wey una get.
- In fact na FULL-TIME job for most Nigerian parents wey get kids for UK...bcos u must to dey watch dem right left and centre bcos of MONSTROUS kids like d one above. Dats why some parents kuku dey pack up come siddon for uk dey train their kids.
- My suggestion to the British Authority be say make dem by-force all their pangolo-children to dey go SUNDAY SCHOOL...so dat Holy Spirit go fit enter dem small.
- Na for only oyinbo land i see say na only old papa and mama dey go church....ee get as ee be o.
- Meanwhile for Africa we dey sleep for church dey praise God steadily.
- To even tink say na dem come give us christianity sef....nawa o.
No comments:
Post a Comment