.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Tuesday, 4 February 2014

FACEBOOK IS NOW 10 YEARS OLD!!!



Facebook celebrates its 10 years of existence today!!! It has 1.23 million readers worldwide, and attracts a record revenue of  2.5 billion dollars from 750 million daily users.

  • Happy Birthday.
  • You don MAKE and DESTROY people like no man's business.
  • Well na their luck...bcos some people sleep and live Facebook.
  • In fact it has made us to know those with very LOW ESTEEM, and those SHOW-OFFS wey be original empty barrel.
  • Nawa...some idiots go dey TOILET, dey tell d whole world for facebook. Others go tell us say dem dey chop chicken for house. Very amusing!!!
  • D tin nawa....some people dey take am open dem YANSH for d whole world, while others dey take am teach us their life history.
  • Oyinbo Director don take am sack eem top employee before...as d idiot go dey pose for facebook after she don drink too much BRANDY while she was supposed to be on Company Trip. Trust oyinbo when dem don shak...she even open bobbi for facebook sef.
  • D people wey benefit pass na those SNEAKY ones dat will go on it everyday without fail, to COLLECT GIST about other people and not say PIAM (anything). D best dey will do is to tick 'LIKE'....hehehe....just to encourage you to tok more.
  • On d whole I kno say facebook don try..bcos ee don FISH OUT some friends wey we for don WRITE OFF.
  • So it is not all a gloomy tale.

No comments:

Post a Comment