.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Sunday, 19 October 2014

FAKE 'YANSH' FOR SALE!!!



O BOYYYY...SEE YANSH OOOOOO!!!

  • Girls with IGBEKERE yanshes do not have to worry anymore.
  • Oyinbo people don produce fake yansh for una.
  • Otherwise known as BY-FORCE-YANSH.
  • So guys...make una dey check and cross-check well well before una propose o.
  • D wan wey go bad pass na if u be like wan friend of mine (a former Major in the Nigerian Army). D guy thin like bongafish, but eem like DUNLOP YANSH..no be small. If dat kain guy go take mistake jam fake yansh...na eem go funny pass.
  • Hehehe...walahi...no black babe deserve dis AGONY of fake yansh o. If na Oyinbo, I can understand. Even sef una go don notice say oyinbo sef don dey get dunlop yansh dis days...abi na change of diet dis days?? Bcos oyinbo for London don dey chop rice like black people now. Before before, oyinbo no sabi chop rice ke. And maybe na black guys dey take hand dey massage d damn tin for dem.
  • D wan wey surprise me pass be say oyinbo don dey sabi dance oooo. If to say una see as dem dey dance for around 1960 and 1970 side, una go CRY.

No comments:

Post a Comment