THERE ARE RIFE SPECULATIONS THAT MOHAMMED BABANGIDA, SON OF FORMER MILITARY DICTATOR, IBRAHIM BABANGIDA, MAY HAVE JOINED THE NIGER STATE GOVERNORSHIP RACE!!!
- SMALL-BOY...No be your fault!!! Sebi politics na money for Naija. The POOR people of Naija State will not say NO to big big bags of rice and bundles of Naira Notes....come election day.
- Sebi na ya papa get Nigeria???Abi.
- All dis yeye awa rulers...after dem don spoil awa country...dem go dey push their pikins to go do us further damage.
- What d 4uk does dis sedately guy know about politics...other than dat 'predatory' urge to always remain at d top of awa society. Is he in touch with REALITY in Nigeria??? NO
- When their papa commot office finish dem go dey suffer from LACK OF RECOGNITION SYNDROME...where no one pays dem any notice, as opposed to when dey were in power.
- Dats why dem go dey push dem kids over us over and over again.
- Ah ah wettin sef...d wan wey una papa don chop never reach???
- Se e fe pa kete kete ni??? (una wan kill donkey???)
- Na so Abacha pikin wake up too..ee say eem wan be governor for Kano State. Hehehe... I dey laugh. Make u no let me tok oooo. Henn hennnn???
- No be all of us get Nigeria???
- Well...I BLOODY WELL HOPE (like many good Nigerians) DAT U DO NOT WIN.
- And by d way...ee be like say dis 'governorship aspirant' dey BLEACH sef. Hahahaha!!! Na another NWOBODO be dis o...HELPPPPPP!!!!
No comments:
Post a Comment