.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Monday, 20 January 2014

LUCKY DOGGY!!!

A tiny pet Chihuahua was found on a busy commuter train at Swansea station by rail staff and is yet to be returned to its owner

The dog was found at Swansea station in Wales and is in good condition

This CHIHUAHUA dog was rescued at the Swansea Train Station in Wales, UK. It had lost its owner!!! It was discovered by a Train Guard in a CARRY CASE on a train arriving from Manchester.

  • See as I dey laugh...I wan piss for body. D tin dey for inside Carry-Case sef. Eem own beta o.
  • Oyinbooooo...una too dey make person laugh.
  • Even d dog name dey make me laugh...ee sound like Edo name!!! Hahaha. No...Ibo name, bcos CHI dey there.
  • Upon all see eem face like one big RAT. Make I no yab am too much, bcos if my daughter hear wettin I dey tok, she go vex with me...say daddy na bush-man, lol.
  • If dis wan lost for Naija road...ee go chop shit taya...walahi. Nobody go look eem face. Even sef small pikins go stone am. And Okada sef go jam am...korrect.
  • Naim be say ee kuku beta make some sufa-head people for my country come back to dis world as OYINBO DOG....abi? Ee beta than to come land second time for dat same Naija, where politicians dey MESKASHIT big-time.


No comments:

Post a Comment