Berkshire and Oxfordshire in Southern England have reported an invasion of rats in homes, as a result of the recent flood. The rats are running away from their usual holes which have been filled with flood water, and seeking shelter in warm homes. These rats are said to be mutant super-rodents that are resistant to rat-poison. The rats are also feared to carry deadly diseases trasferrable to humans.
- Na small yeye rats oyinbo dey fear??? All those una fat fat dogs no fit kill rat for una? Sebi na inside house, on top bed una dogs dey sleep? How dem wan see rat, when dem don over-feed. Some dey even chop beta chop pass dem owners sef. lol.
- When some people dey chop rat for China and Thailand sef....una wan dey waste rats here. lol. Chinese people dey even use am for juju sef!!!.
- Even sef wettin we dey take rat do for Naija...na so so kill we dey yamutu dem. Dem boku for every corner.
- For villages dem dey even follow us chop awa garri for under bed sef...not to tok of some of dem dey enter pot of soup for kitchen wack meat well well.
- Dem never use beta poison for d damn tins...make dem go Naija go buy all dat rat poison wey all those boys dey sell for traffic...na one-time dem go yamutu.
- Wettin be rat...rat ko, rat ni. AJEBOTA RATS for dat matter.
- But sha...dem never born dat rat wey go fit transfer disease to person for Nigeria....walahi. When we keep bread for on top table, and rat chop one side for night, we go wake up chop the other side for morning...no quarrel. Na live and lets live. RAT RULE OK!!!
No comments:
Post a Comment