A British woman, Natalie Thomas, who visited her daughter on holidays, in Egypt claims she almost lost her breast to a mosquito bite, as her breast turned black, and purple before beginning to crater. Surgeons cut more than an inch into her breast to remove tissues because she had contracted deadly nectotising fascitis, a bug that eats away skin, fats and tissues, causing gangrene. She claims to have swam in a stream full of algae, soon after being bitten, which may have explained how she got infected.
- Na God Jesus save you...you for forfeit all your bobbiii.
- I for say...which kain mosquito be dat sef? Sebi my granmama dey expose breast dey go farm for village before before...even lion no fit bite dem bobbbi. Na ordinary mosquito bite you wey you dey make noise, dey get black, yellow, green breast. Nawa for oyinbo. Una no sabi wettin suffer resemble.
- And Oyinbo too look for wahala. You leave better water for your hotel, go dey swim for stream full of algae....so make u no blame mosquito for starting d problem ke. Mosquito na normal normal for Africa. Wettin you go talk if you face d mosquioes wey dey for Maroko...or even Makoko??? You go bowwwww. Naim be say you go just die patapata.
- Mosquito RULE for Africa. Who no know go know.
No comments:
Post a Comment