Doctors treating Nelson Mandela, the former South African President, have advised the family to authorize the switching off of the life-support machine presently sustaining him, as he is in a 'permanent vegetative state'. He cannot breath without the machine.
- Jesu Olodumare. I dey fear o...Na so human being dey degenerate? No be d same Mandela wey commot for prison the other day here, dey fight oyinbo people?
- Una wey be scientists...why una never find solution to living long nowww??? Una dey disappoint me too much, especially d oyinbo ones...cos i kno say na so so eba d naija scientists dey take their own brain dey chop. Me as you see me so...I no wan die o..bcos life too sweet, even if man no get money. But when you come get d money...chaiii... na 'yours truly'...original jolification. You go just dey smile when you dey sleep sef.
- Anyway God don tok say everyman must reach his own 'bus-stop'. Dats why 'its good to be good'. Make una tell awa useless leaders. Life is too short for dis una nonsense. All dat una billions no dey go with una. Na ordinary 6ft we go dig when una kaput. And then coming governments go seize all una money. Una children go start dey beg for food. Go ask children of yester-year leaders. Dem go tell you beta story.
No comments:
Post a Comment