Tony Umole, the Nollywood actor, who acts the role of 'Daddy' in the TV series, One Love, is dead.
This is another tragedy for the Nigerian Film Industry, Nollywood.
- RIP...my man. Say me well to 'Andrew', Enebili Elebuwa, and good old Justus Esiri.
- Tell dem say we never reach awa own 'bus stop' IJN (In Jesus Name)...amen. We still dey jolificate here for mother-earth.
- May his family have the fortitude to bear d loss.
- Nollywood people, make una dey take style contribute to charity o. All dis fat salary wey una dey make. Some mumu people among una dey take am buy unimaginable moto like 'Ferarri' come dey shak people for nigeria...when majority of awa people dey hungry. Una don forget d days when una too dey starve, running from pillar to post? You no go carry ferarri go inside grave o.Na wettin you impact on peoples lives dem go remember you for.
- Poverty no good o...D problem be say some of una don suffer too much before una see dat money...so dats why una dey 'go to town' when una see small money...abi? Una vulgarity dey too much..even d women among you dey worse. D kain cloth wey una dey wear now na disgrace. Una go expose bobbii, open yansh. Make una remember say we get awa culture o. We cannot do like oyinbo people...nmm nmmm...ee no possible. Oyinbo no get 'iran' (roots). Oyinbo fit call himself ? Mr. John...but in your own case, your name get meaning. Once you mention am, we sabi which village and house you come from...okay o. I don tok my own.
No comments:
Post a Comment