Governor Fashola of Lagos State says the long-awaited Cable-Car Project is almost ready. He claims this mode of transportation will transit between Apapa and Falomo, via Lagos.
- Fashola...you be bright boy, but you too dey dream. Dis time you don FAIL WOEFULLY.
- Dis na wettin I call FASHO-NONSENSE....White Elephant Project.
- Una never cure d rubbish go-slow for ground una dey tok about Cable Cars. I dey sorry for una. Instead make you repair your roads and improve road transport you wan make Lagosians start dey FLY...abi? Na d people wey d tin go drop for dem head I dey sorry for...not d people wey ride on it....bcos dis na DEATH WARRANT. Associated Airlines go beta pass am.
- Wey d NEPA sef? When ordinary traffic light no work.
- Woe betide whoever goes on dat BULL-SHIT DANGER TOY....Se una no kno say Europeans wey dey use am get beta Maintenance Culture and Power Supply pass una.
- Fashola...u dey disappoint me...walahi. Dis is just another way to award BIG CONTRACTS through your SURROGATES...Abi na Tinubu bring d Contractors sef? I also hope dem be Chinese...as usual.
No comments:
Post a Comment