.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Thursday 12 September 2013

A WHOLE LOT OF 'SHIT'.

The 20-month-old boy from Yanji, in China's Jilin province, tumbled into the pit when he failed to keep his balance

This toddler in Yanji, North East China, fell into a 'shit-pit' below their toilet, while attempting to use the toilet (above).

  • Dis na wettin we dey call SHIT CHOPPER!!!
  • Dem still dey use SHALANGA for China? 
  • Naim be say dem go get AGBEPO (Night Soil Men) for China...no wonder Chinese people no dey mind stay for face-me-i-face-you when dey land for Naija....APURUKA people.
  • In the 60s and early 70s in Lagos, many face-me-i-face-you houses did not have water-system. Na AGBEPO dey come carry their shit once a week with massive buckets. Dem go cover their faces. And we small pikins go dey call dem AGBEPO from afar...but if dem catch you...your own don spoil be dat...Dem go dip broom inside their bucket and sprinkle on your face. If you pass dem for road, and you cover your nose, na anoda wahala...so you had to keep a straight face, and endure d SCENT. Lol. Those were d days.
  • Come to tink of it now...e no easy o...those guys were peoples fadas...and na unemployment/survival make dem dey carry shit for head... O boy Life hard o!!!
  • Anyway dis foto above looks like d real SOAK-AWAY...it must have given way. Maybe d boy papa na SUMO WRESTLER. Eem weight don weaken d structure plus eem heavy heavy OROBO shit.
  • Dis poor chap....ee no go fit chop for the next two days. Him bele go swell, no be small. Kai.

No comments:

Post a Comment