.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Friday 27 September 2013

OKADA MAN GIVES UP ON LIFE!!!



Culled from The Nigerian Tribune.
This OKADA RIDER in Ibadan, Oyo State, flung himself under a truck (and later an SUV) in a frantic suicide bid, because officials of the State Commercial Vehicle Registration Unit impounded his Bike, alleging that his documents were FAKE. Despite being prevented from killing himself by on-lookers, he still ended up in a state of stupour/shock, foaming from the mouth. He was later whisked to the Adeoye State Hospital by Police.

  • Nawa o...dem don tok am for Yoruba say...OLOWO LO MA KURE (na rich man dey die korrect death). As for poor man...na JEPEJEPE death dem dey die....like fowl (chicken).
  • Dis na awa history o....D poor guy obviously saw his LIFE flashing before his very eyes. God knows how long it took d poor geezer to put together d cash to buy d damn moto-cycle in d first place.
  • Dats why he kuku say...well UNA DON KILL ME BE DAT PATAPATA FINISH....wettin remain.
  • I can understand d guy o...and I bet my last dollar dat he genuinely paid for authentic documents, but got fake ones...courtesy of the syndicate LEGITIMATELYoperating outside the Licencing Office.
  • D government people should go after the TOUTS dat hang around Council facilities/offices, selling fake papers. Sebi na d government workers demselves dey support those touts. Abi who dem dey work for? Who dem dey DELIVER to? Afrerall no be say d poor guy siddon for house come produce fake documents. Na for una Local Government Licencing Office ee for buy am. And how is he supposed to know it is fake?
  • Those useless people wey seize d bike wanted EGUNJE..full-stop.....bcos there is no way dem go release d shit without dat guy parting with big money...and d guy look up, look down, sotay ee come tok say...IF UNA SELL ME SEF, UNA NO GO SEE SHISHI (single kobo)....so make I kuku die for una neck. Dis wahala too much sef...abi na me KILL JESUS??? Wettin sef???
  • Well I hope he survived d COMMA....poor chap.

No comments:

Post a Comment