A Report has shown (according to Daily Mail) that Facebook recently lost 11 million Users in the USA and UK, due to concerns over Privacy, Fear of Addiction, and Shallow Conversations!!! Researchers from the University of Vienna also cited Data Protection issues, plus the undue pressure on people to Add Friends, as the other reasons for loss of subscribers.
- Everybody with their own PALAVER.
- Some people no fit pass wan day without Facebook. D tin don become addiction.
- D tin don MAKE some people, while at d same time ee don DESTROY others. I know wan oyinbo guy wey lose him job bcos his employers see am for facebook dey get drunk, and disgrace himself for party. D useless guy enjoy xmas party sotay...he go undo d flap for him trouser to FLASH him small prick...tink say na joke he dey joke....in front of people wey dey pour drink for him head. By d time he reach office d next day na sack letter dey wait d mumu.
- D wan wey dey make me laugh na when one yeye husband go go on Facebook to ask him wife say DEAR, WETTIN WE GO CHOP TODAY?. And dat wan too go answer am for on top Facebook. Sometime sef dem go put foto of d food wey dem chop.
- All dat na joblessness, and na for SHOW PIECE PEOPLE wey no get confidence in demselves. ...small time sef na SMALL CRAZE dey worry such people...but dem no know. And Facebook don bring d craze out for every wan to see.
- Some people wey poor pass CHURCH RAT go dey pose on top Facebook say dem go Holiday for Orlando etc etc sef...all na BOBO. By d time you find out you go see say d guy no fit chop tomorrow lunch.
- Anyway eee get as eee be. D guys who started Facebook must have had Nigerians in mind....walahi.
No comments:
Post a Comment