The 29-year old son of former British Prime Minister, Tony Blair got married to his 25-year old sweet heart. The bride and groom used a LONDON BLACK CAB for the occasion.
- NAIJA people...make una take some lessons in SIMPLICITY and MODESTY.
- Una see as RICH/BETA people dey behave like NORMAL PEOPLE?
- If na una...poor struggling men go go hire Limousine, and chop GBESE put for ground...even when money no dey pocket. Na do or die for us...BY FORCE enjoyment.
- Tony Blair no be small guy o...bcos na next door to my house he dey live for Buckinghamshire (TONY BOY). Se una see eem house for dis foto. If u look well u go see my own behind am...somewhere. Na dat tree cover am.
- When una finish una go dey SWELL, DEMO and MESKASHIT...when una no even get NEPA. At d end na generator una go take do d party sef? God help Naija.
- I hear say some of una Musicians, Senators, and Actors/actresses dey carry awa money take go for DUBAI go do wedding? Una dey craze for head o....on what basis. Which wan concern ARABA for una life? Do u tink dem GIVE A 4UK? All you are doing is burning out awa resources out there, and making a ridicule of yourselves...when u can take d money to feed all those wretched people for your village and family...abi I tok lie? Useless lots!!! No sense for una DICK HEADS.
No comments:
Post a Comment