.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Thursday 19 September 2013

EMBALMING FLUID USED FOR FATTENING MEAT IN SAPELE!!!



The above traders were arrested in the Sapele area of Delta State, by Health Officers. They were caught using embalming fluid to fatten cow skin, locally known as POMO. They are said to inject the embalming fluid chemical (usually used for corpses in mortuaries) into the meat, and then soak then in water to swell before selling them to Restaurant owners.

  • Naija...poverty don CRAPE UNA HEAD.
  • So na dat dangerous chemical wey dem dey take treat DEAD-BODY una dey give us chop?
  • Over to you BUKATERISTS out there...una wey dey chop for dirty bukas all over d place. Some of una prefer buka food pass your wives food sef.
  • I hear wan time say one woman for Tinubu area dey even SHIT put for eem food before she cook  am for her buka. COOKED SHIT....dat must taste sweet for people to be patronizing her. As a matter of fact her own na JUJU she take am dey do.
  • D women for dis foto...their own be say dey want make d pomo plenty well well....poverty no good o.
  • Na d person wey chop am I dey sorry for...na eem one of my friends dey call JE MI MA GBAGBE (chop me and remember me)...d wan wey go land you on top toilet all night...wey your eyes go dey turn like siren, and your body go dey sweat like say dem pour water for your head....and YANSH go dey pepper you. (sounds familiar...abi).
  • But having said dat...all those AGBERO boys dey chop am neat neat...na only smelly MESS dem go mess...natin natin dey worry their bele. Their bele na SOAK-AWAY PIT.
  • If person wey just land from London or America, after eating beta McDonalds, go chop dat kain tin...NA HELELE o. You are on your own o. Me I don tok my own.

No comments:

Post a Comment