.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Sunday 29 September 2013

FIRE AT YABA COLLEGE OF TECHNOLOGY.



The Arts Complex of the Yaba College of Technology, Lagos, was gutted with fire early morning yesterday. Several documents, including past question papers and scripts were destroyed. The State Fire Service were there to put out the fire 50 minutes after it started.

  • I hope say no be SABOTAGE o....bcos some yeye professional students no like exams, at all at all.
  • Also how come it took 50 minutes to put off d faya...we go need to brush up for dat area, bcos for oyinbo land wey house dey burn like paper bcos dem dey pipe gas lines through their walls...Faya Brigade dem no dey waste time to respond and quench faya. Awa own houses na APURUKA blocks we take build dem, so dey are not as combustible as oyinbo houses....and yet???.
  • Also we need to improve on our HEALTH & SAFETY at work places in Nigeria. I sure say dey no get mandatory standards, and dem no dey inspect dem to see if dey are equipped with ordinary functional FIRE EXTINGUISHERS. All dis tins no be joke. Ee get as oyinbo dey do am wey dem System dey work. No be say una go keep faya extinguisher wey dem don instali since 20 years ago...d time wey dem build d house. Abi una no kno say d tin dey EXPIRE???
  • We need EDUCATION...full stop. Even awa leaders sef need am BADLY. Bcos if dem no kno...how dem wan make laws, not to tok of enforce d Laws?
  • I don tok am say GOD LIKES NIGERIANS too much...if not, we no get SHISHI for yansh. Na so so MOUTH WE DEY.

No comments:

Post a Comment