.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Tuesday 17 September 2013

ABACHA'S SON RETURNS TO PDP.



Mohammed Abacha, the son of former Dictator, General Sani Abacha, declared his return to the PDP Party, and by implication his loyal support for Jonathan's re-election. It is widely speculated that the Abacha family has recently benefited tremendously from President Jonathan's 'good will'....what ever that means. The recent release of Al Mustapha is not unconnected to this.

  • Come o...make una TAKE TIME o...Mr Jonnah...abi dem curse you? You should be busy trying to force dem to return all awa money wey dem steal go place for Switzerland and UK. 
  • Which wan concern you with dis OUT CASTS? I am not surprised dey are trying to BEFRIEND Jonathan. Sebi dem still get billions of $$$ stashed abroad.
  • I don tok am say awa problem for Naija be say we get shallow and short memory. We no dey remember d sufa wey awa body sufa in d past...once we don start dey enjoy small beta life. Just d same way as we no dey remember d good deeds of our REAL HEROES past...what a shame.
  • Dis are d kain people wey for dey hide dem face for Naija of today...but instead una wan start dey glorify dem once again...abi? Bloody broods of TYRANTS.
  • I hear say dis guy wan run for Governor of Kano sef. Ha Ha Ha...Nigeria we hail thee!!! If no be say awa head no korrect for Naija...who d hell is supposed to vote for dis 4uka. But mark my words...dem go push am sotay ee go WIN.
  • So make una look eem face well well...Dis na una KANO STATE GOVERNOR...come 2015. The deal is DONE. Dats why poor man go die poor for dat 4ukin country...No hope for una.
  • Like fada like son...when ee reach there d people of Kano have my sympathy...dem go see WHINNN. D guy go resume CHOPPIES like eem papa....with a vengeance...bcos as far as dey are concerned dey have not forgiven Nigeria for d way we 'treated' dem. So make una no deceive una selves.
  • Bottom line be say  weda he good o..or he no good o...Your papa don spoil ground finish patapata. Nigeria is suffering today mainly bcos of your papa and dat 4ukin geriatric DEVIL dem dey call IBB.
  • So please Mohammed, or whatever dem dey call you...GO TO HELL....and I mean PERFECT HELLLLLL FAYAAAA.


No comments:

Post a Comment