.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Tuesday 24 September 2013

PRESIDENT JONATHAN SAYS HE WILL RUN IN 2015.

2015: I will run – Jonathan

President Goodluck Jonathan finally broke his silence in New York, on Sunday, while answering questions by saying HE WILL RUN in the 2015 General Elections. He said, the Nigerian Constitution provides for two terms of eight years, and that Nigerians should dwell more on the performances of whoever is in power, and less on politicking. He claims his government has PERFORMED well.

  • Oga Jonah...are you SURE you have the STOMACH for dis job? Abi na Madam Patience dey PUSH you? Bcos I kno say na women dey enjoy position pass their husbands wey dey there sef. And from all indications, your madam na ORIGINAL GBALADUN WOMAN. Even sef we hear say na she dey keep some non-performing ministers in position...after dem don SEE AM. (and we all know wettin SEE AM means)....'See am' and Ghana-must-go bags are synonymous. 
  • Me, I only want you there bcos I feel there is no basis for d power returning to d North...not bcos I like your CHARISMA....you have none. You are TOO FLAT. You need SHOCK TREATMENT to ginger you up.
  • For most Nigerians it is what you symbolize dat matters....FULL STOP.
  • Sometimes I wonder how and where you got your Phd. For you to open mouth tok speech na wahala. D tin too dey shame me when I dey see you dey tok for TV...ee come be like say dem dey mal-treat you...like wettin Yoruba dey call OMO TIO NIYA.
  • Abeg make you go KENYA go hear small boy...Uhuru Kenyatta tok. It is INSPIRING!!! You need training for dat area...badly. How you dey even understand oyinbo people whenever you go all dis so-called international conferences wey you dey waste awa money dey go. 
  • Well sha...may be by d time you reach your 8th year in office, you go sabi to carry us along.
  • In d meantime GOODLUCK to you, Goodluck.

No comments:

Post a Comment