.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Wednesday 25 September 2013

TOO MUCH FOOD IS OFTEN THE PROBLEM.

granny

This 64 year old woman weighed 17st 12Ib, and had breathing problem. She dropped down to 8st 7Ib after doctors told her she stood the chance of dying. She changed her diet and took up WALKING.

  • Se una don hear...una wey dey chop RICE for morning, EBA for afternoon, and POUNDED-YAM for night....na garbage in, garbage out o.
  • I hear say some people sef dey chop am dey come NAK Beer (GULDER) on top...korrect. Dat na body-assault.
  • To gain weight dey easy, but to lose am na WAHALA.
  • And for Naija, I don notice say ee hard for BIG-MAN to walk...na so so moto with AC naim dem dey take waka. Dem no dey even drive sef...wettin dem dey take driver do for Naija (dozen a kobo). Even sef to buy tins/provisions dey easy for GO-SLOW....dem go dey beg you sef, dey run after your moto. Dats why una big-men dey PEG-OFF any how like flies, after amassing all dat money/ota/ego/kudi. Una no dey do exercise. Especially those wey live for high-density areas like Lagos Mainland, wey space no dey to say you wan stroll. Dat wan be say na DANFO go break your leg....abi make Area Boys tear your sokoto. Lol. 
  • We wey dey for LEKKI wey fresh air and open space dey...you go notice say we dey live longer. Lol. Even poor man for Lekki dey live stress-free life pass big man for mainland....except dis wan wey Fashola and him broda Tinubu don make life a nightmare for those along d AJAH axis....dat una express road wey no go ever finish.

No comments:

Post a Comment