.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Sunday, 10 November 2013

NIGERIA FROWNS AT CAR IMPORTATION.

cars

In a bid to encourage its comatose Car Assembly Plants, Nigeria is frowning at Car Importations. Nigeria spent N1.05 trillion on car importation last year alone. Meanwhile the Peugeot Automobile of Nigeria (PAN) which produced about 90,000 cars in 1985 with around 4,000 staff strength, now only produces 3,000 vehicles annually with 250 staff strength. The Directors of the PAN claim that ban on importation will help their industry grow!!!

  • Real BULL-SHIT.
  • When PAN cannot even cope with producing vehicles to meet demands for the smallest State in Nigeria, dem dey get mouth to tok?
  • Una don chop all d money wey una for take produce.
  • Go to India and see how their local MARUTI Vehicles are doing well, and enjoying good local patronage.
  • Well una go see wettin una dey look for...we are only going to make Coutonou (Benin Republic) richer, bcos Nigerians go dey enter bush go dey import cars by illegal means. It has happened before. Una no dey learn from una MISTAKES. Foolish leaders.
  • Bottom line is dat if una produce good local cars at good prices, people will buy. After all who does not like cheap article??? Go to India and see.
  • Se na 250 Staff strength wan produce moto for d whole Nigeria??? Abi?. Una dey craze for head.
  • D tin wey dey pain me pass be say d BIG MEN go still dey import their own cars o. Me I don see where ABACHA eem people, plus dat useless Major Mustafa import Limousines for Northern Emirs through Airport before...even tho dat time dem say no importation of Cars allowed. Dem no tell me...I SAW WITH MY OWN EYES. Dem quench light for Kano Airport for up to one hour, just in order to land d cars and check dem out of d airport to all the Northern Emirs. (One Nigeria ko, one Nigeria ni).
  • So who dey deceive who???? BABANLA NONSENSE.

No comments:

Post a Comment