This 30-year old man from Dagestan was shot severally by two RACIST Russian gunmen on a Moscow Metro, in a racially motivated attack. Police released this CCTV footage in order to catch the culprits. They both fled the train at the Nagornaya Station. The victim miraculously survived but is receiving intensive treatments. Russia has been recently involved in multiple racial attacks on immigrants, including racial booing of black players at football matches. Russia is supposed to host the Winter Olympics in less than 3 months.
- For God's sake...which kain human beings be dis??? What on earth can make a man do dis to another man?
- Make una just know NOW say blackman no get CHANCE for dat gaddem place...if dem fit attack their own fellow oyinboman like dis...altho we agree say all of dem na JAPAJANTUS oyinbo breed.
- Anyway sha...me I don kuku tok am say there are some places in dis DAMN world wey I no go EVER VISIT...even sef if dem carry my dead-body go there, I go WAKE UP...walahi. Russia na one of dem. Dem be EXCUSE OYINBO (jepejepe, japajantus oyinbo).
- On d other hand I dey sorry for those wey find demselves for such places...ee get as ee be. NA CONDITION make crayfish bend. When Naijaman look sotay, ee no fit chop ordinary garri for him own country, ee go VAMUS go anywhere...even cross desert sef.
- My advice to fellow Nigerians be say...even tho we kno say some oyinbo people no like black people o...But make una try dey go d countries where dem get HUMAN RIGHTS, and small respect for human beings. Russia no be one of dem ooooo.
- Some APURUKA countries like Russia no get respect for Civil Rights, and fundamental Human Rights. YOU ARE ON YOUR OWN in such JUNGLES....period. Dem no even see you as human being sef.
- If you stay your village for Naija dey chop PAKI (cassava), or AKPU (cassava), your own beta pass you dey go Russia, Libya, and all those rotten holes....after all how many lives you get, wey you wan go waste am for oyinbo hand???
- Kaiii...see as d tin dey PAIN ME.
- God go punish awa leaders for spoiling awa country o.
No comments:
Post a Comment