.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Sunday 8 September 2013

SAYING IT LOUD!!!


George Lucas, Star Wars Director (net worth $3.9 billion)


Robert De Niro.


Janet Jackson and Wissan Al Mana (net worth $4.5 billion).


Prince of Liechtenstien and Princess Angela Brown.


Iman and David Bowie.


Peter Norton of Norton Securities.


  • SO OYINBO MEN SEF LIKE BETA TIN!!!
  • For naija, we no dey chop FROG, but if person (woman) decide say na frog she wan chop....make she PLEASE chop the wan wey get EGG for BELLE...abi?
  • Me I don tok my own o...bcos I dey see some yeye black women for London wey dey go marry Labourers, and chavvy low class Oyinbo men wey even dey collect government welfare, all bcos dem wan get PAPER to STAY.
  • Dat wan don pass BE CAREFUL. Before before na South African, Zimbabwean, Kenyan and other East African girls dey do am for London, but now awa own girls don start am. Una no see una mates for dis foto??? Dem get two heads? Make una take una time o!!! Lol.
  • On d other hand, d Oyinbo men (those Embassy types) wey dey pik dem own women for inside Nigeria...most times na Ashawo/Shara dem dey pik....so dat wan no impress us o. If you marry your own oyinbo for Naija, we no go respect you o. Some of dem even get wives for their country. Na your YANSH dem wan nak for hot and sunny Naija....full stop. 
  • Na dem we dey call NFA (No Future Ambition)....upon all na ordinary salary d man dey collect. Tomorrow now dem go transfer am go Russia...then your own don finish. You fit compare am with beta people for dis my foto??? Ennn??? Lol. Make una no start wettin una no fit finish o, bcos oyinbo no send anybody MESSAGE o..

No comments:

Post a Comment