.adslot { border:2px solid aliceBlue; margin:2px; }

Total Pageviews

Blog Archive

Sunday, 22 December 2013

PASTOR OKOTIE BUYS N120 MILLION ROLLS-ROYCE!!!



Pastor Kris Okotie of the Household of God International has landed a brand new N120 million Rolls Royce Coupe, 2014 Bespoke Edition, to mark his 27 years as a Pastor, and 30 years as a Born-Again Christian!!! He had earlier bought a Range Rover Autobiography SUV worth N33 million purportedly as a 'Milestone of his Ministry'!!! It would be recalled that Okotie was recently in the news for saying that all Catholics are going to Hell.

  • OTIEKO!!! Make I call you by d name we used to call you when we were in school back in the early 70s.
  • You no go fit change...u dis RASCAL. You too like beta tin. I remember me and dis guy once chased two sisters back then in awa teenage years, and he insisted on d more beautiful wan, even though na me invite am. We almost fought over the matter. Good old SWINGING 70s.
  • By d way... I dey sorry for you young people dis days. Beta chics don finish for Nigeria. I hear say una no get WIFE MATERIALS again....kai. Dat na wahala o...naim be say dem pour sand sand for una garri.
  • (To come back to Okotie matter) Anyway dats why I no dey surprise to see all d fine fine women (BABES) wey my friend dey marry everyday!!!
  • I also kno say he go like FINE WINE well well...like me. D guy na STYLISH dude. We go give am dat wan.
  • But sha...dis your moto na SHERUBAWON o. You don HAMMER your congregation Finish...patapata...Finito.
  • Ee be like say me sef go soon become GOD'S SHEPHERD like my friend. Abi how for do...when there are so many gullible people in Nigeria ready to sell their homes to SOW SEED for Pastor.
  • But sha...are you telling me dat there are no people for your church wey dey take leg dey waka? D money wey you take buy dis BEAST go fit feed your gongregation for over a year...neat neat. My own problem be say MY CONSCIENCE no go gree me to even drive ordinary BENZ when I kno say my disciples dey STARVE. Nawa for una o!!! Human beings nawa.
  • As for d tin wey you tok about Catholics...I tink you DEY CRAZE for head. Even tho u be my friend, I must tell you d truth. You don dey KOLO small-small. You need a WIFE to give you regular 4UK, so dat your head go TUNE BACK to Station. After all Pastor sef dey 4UK...sometimes too much sef, even pass normal. 
  • And if I kno you well you no mean am. You just dey seek ATTENTION. You kuku like Controversy well well. Anytin to capture people's attention. Showmanship.
  • Na so I laugh sotay d time wey you tell Nigerians say GOD tell you say na you go win election for Nigeria. HAHAHA...I still dey laugh. 
  • OTIEKO himself. D original SHOW-MAN. Carry On broda!!!

No comments:

Post a Comment