An Egba High Chief and Senior Lecturer at the Olabisi Onabanjo University, Ogun State, Dr. Gbenga Dally, has died in a ghastly multiple auto accident, wednesday evening along Abeokuta/Shagamu Road. The accident involving three vehicles occurred near Onipepeye Village, about 30 kilometres from Abeokuta.
The late University Don owned a school along the Abeokuta/Shagamu Express Road.
- RIP Sir...May his family have the fortitude to bear this great loss.
- Now...wettin dey do dis awa government wey be say if robber no kill person, na road accident go kill dat person? Is it a sin in Nigeria to live up to 80-90 years of age?
- For oyinbo land dem no know wettin to do with old people again... bcos dem no wan die...For London, Old Peoples Home don full, bcos die no dey dem eye o. Dem dey chop beta food...no robber, no pot holes for road to kill you. Naim be say you don reach heaven before you die sef.
- Abeg President Jonathan...make you do sometin now!!!. One day na one day. You sef go fit get close relative wey go kaput for those awa 'death traps' wey you dey call roads. Ok o.
- D funny tin be say when State Government wan repair road, Fed Gov. go dey vex say make dem no touch am. Ee be like say una dey craze o. Dis na d height of selfishness.
No comments:
Post a Comment