Dr Jinaid Muhammad, Second Republic Lawmaker, has called the First Lady of Nigeria, Dame Patience Jonathan, an 'illiterate'. He says Rivers State is coming into limelight because of the irresponsible, unconstitutional, and bizarre illiterate action of the First Lady, who hails from the 'small island village of Okrika', and sees the whole of Rivers State as her personal property because her husband is Mr. President. He claims that through her influence, the Rivers State Commissioner of Police, and professional thugs are being hired to destabilize the Government of the State. Muhammad further stressed that Nigerians must stand firm against Jega's INEC, because he (Muhammad) has no confidence in the 2015 elections, more so because the present Chief of Army Staff, General Ihejerika is an Inlaw to Patience Jonathan.
- Oga Kofessor, abi na Doctaa...I no kno say na so una dumb for head. Are you telling us to believe that because Ihejerika na Patience inlaw...naim be say election go flop? Well dis na 'crying wolf'. When it was mallam turn in government, even una houseboy (boyboy) sef dey enjoy power. So don't give me dat BS (bullshit).
- D tin dey pain una like say dem cut una with knife. Make I tell you now...Ogbemudia don tok say Jonathan go finish him term. Den after dat na my inlaws...d Igbo people. So make malam go siddon for corner for now until we send for una....gaskiya...segobe.
- Which wan concern you with Rivers problems sef? Which time u begin LOVE Niger Delta people like dat. My friend...go siddon. Na power dey hungry you. Make mallam go do 'day's job' for a change like d rest of us.
- Na so so 'gomant' (government) malam dey look for. Una dey forbid to set up business like Igbo people??? Ah ah wettin sef. Monkey work..baboom dey chop. Na dat chop go kill una.
- Even sef..if Patience na illiterate..so what?...na everybody must go school? At least she fine for face. Which school you yoursef go? Docta ko, docta ni.
- Wettin Patience do sef..wey Mariam Abacha, abi Turai Ya' Adua no do worse???
No comments:
Post a Comment